Nasboi say me I no get value. I don dey follow this guy work since 2022. I dey go follow am work for him place for Lekki. I dey take Uber go there based on say when I enter motor all those drivers go carry me dey do shakara, some go say them no fit carry me. Him call me for AY show say them go pay me 200K. I think say na one day work wey I go just go there come back… I tell my manager say I no get money him come say make I follow nasboi talk make him send me money for transport based on say I get body because those drivers no dey carry me. I come tell am make him send me the Uber money make I come o. Na wetin I tell am, make Una hear wetin Nasboi tell me. E say me I no get value. Say me I get value wey people dey look for. I no get value since 2022 wey me and am done dey work, na now I no get value again…”
SB E-news.

